Heart of Arts

Nigerian Pidgin English language Poems

Chidi Anthony Opara

 

(1) Prof Prof:
Im yard people,
Im area people,
Im work people,
Im friend dem,
Even im enemy dem,
Dem dey call am prof prof.

No be say im be prof,
No be say
Im go school like dat,
Only be say
Im sabi speak grammar well well.

Everytime,
Everyday,
For im yard,
For im area,
For im work place,
Na so im grammar
Go dey sound
Dim, dim, dim.

Im yard people,
Im area people,
Im work people,
Im friend dem,
Even im enemy dem,
Dem dey call am prof prof.

(2)Naija Dey Dishonour Honour
Every where,
Even before before for Naija
Dem dey take honour
Tell country people
Wey do better thing dem
Well done.

Person do better sport
Dem go take honour
Tell am well done.
Person write better write write
Dem go take honour
Tell am well done.
Person play better politics
Dem go take honour
Tell am well done.
Person do better business
Na honour dem go take
Tell am well done.
Better every every
Dem go take honour say
Well done.

Now di moto don enter reverse,
Now
Naija dey dishonour honour.
Today dem go catch country person
Wey dey thief Naija money,
Tomorrow dem go carry am go court.
Next tomorrow
Court go give am bail,
Case file go waka,
Case go finish.

Next year
Di country person
Go show for honour,
Naija dey dishonour honour.

(3)Probe Me, I Video You:
For Naija,
Probe na im be di work,
Di main di main work
Wey politician dem dey work.

Presido people
Dey probe legislate people,
Legislate people
Dey probe Presido people.
Presido people,
Legislate people
Dey join hand probe court people.

Naija
Na so so probe probe,
No action.
Sotay four years go pass,
Dem go meet voter dem again,
Dem go get another four years,
Probe probe go start again.

Dem don carry probe
Enter another level.
Probe me,
I video you
Na im dey now.
As one group
Dey probe another group,
Di group
Wey dat group dey probe
Dey video
Dat group wey dey probe dem.

As probe report dey show,
Video film dey show too.
Argument go full ground,
Probe report go die.

(4)Wahala Full Naija:
Everywhere for Naija
Na wahala.
For right
Na wahala.
For left
Na wahala.
For centre sef
Na wahala.
Wahala full Naija.

If e no be “Igbo Presidency”,
E go be “Yoruba autonomy”.
If e no be “Ogoni self-government”,
E go be “Ijaw republic”.
If e no be “Boko Haram insurgents”,
E go be “former Niger Delta militants”.
If e no be “cashless economy”,
E go be “five thousand naira note”.
If e no be “subsidy scam”,
E go be “Bakassi”.
If e no be dis,
E go be dat.
Wahala full Naija.

Even inside di Villa,
Wahala don enter.
Madam di madam
Dey for yonder
Dey take treatment
For belle bite.
Wahala full Naija.

 

Chidi Anthony Opara is a Poet, Professional Fellow of Institute Of Information Management Africa, MIT Chief Data Officer Ambassador, Registered Freight Forwarder and Editorial Adviser at News Updates.

More about him here: https://independent.academia.edu/ChidiAnthonyOpara

Follow us

Don't be shy, get in touch. We love meeting interesting people.

× Let's Chat!